More dan £2m na im dem spend for Harrods on behalf of one Nigerian oil minister wey dem dey accuse say e collect bribes from pipo wey wan get government contracts, na wetin one court for London hear during di sitting of di trial.
Diezani Alison-Madueke, 65, allegedly dey “live life of luxury for United Kingdom”, including multimillion-pound house, chauffeur dey drive am, private jet travel, and £100,000 cash. Oda benefits wey she allegedly don enjoy na £4.6m wey she spend to refurbishing one properties for London and Buckinghamshire, na wetin dem tell di trial for Southwark Crown Court.
She deny five counts of accepting bribes and one charge of conspiracy to commit bribery.

