Popular Ghana and Nigeria feem actor, John Dumelo don win Ayawaso West Wuogon parliamentary constituency seat.
Di Actor and businessman win to represent di pipo of Ayawaso West Wuogon constituency.
Dis na afta im fight off strong competition from di incumbent MP Lydia Alhassan.
John Dumelo bin dey try to win dis constituency since 2018, but im lose by close margin for di 2020 poll.
But dis time, di actor-turn-farmer win wit plenti margin.
Breakdown of di result
Afta sorting and counting of votes, John Dumelo beat oda contestants to win di MP seat as im poll a total of 40,561 votes.
John Setor Dumelo (NDC) – 40,561
Lydia Alhassan (NPP) – 27,377
Abdul Rauf Abugri (Independent) – 189
Total valid votes – 68,127
Total rejected ballot – 257
Total votes cast – 68,384
For im victory speech, John Dumelo tok say “Ghana pipo don dey ask for change wia dem show say if you no work well, wey you be arrogant, di pipo go take you out.”
“Make e no enta our head, dis na good lesson for everibody wey dey come, e no be about moni, dis na about development of di pipo and wetin dey want.”
“We go do our best for di next four years and change Ghana and move am for di right direction,” John Dumelo tok.
Meanwhile, congratulations don dey pour in to celebrate di victory of the actor wey no only dey popular for Ghana but for Nigeria and Africa entertainment industry too.
Who be John Dumelo?
John Dumelo na popular guy for Ghana media space.
E bin start im career as actor and tori be say e become di first Ghanaian celebrity wey go hit one million followers for Facebook back in April 2014.
Dumelo don act for many movies and tv shows and e dey most popular for im roles for di 2024 feem Hijack ’93, and di popular show Suncity.
Apart from acting, 40-year-old Dumelo e dey popular as businessman and farmer.
E first pick up ticket to contest wit NDC for di 2020 December elections for di Ayawaso West Wuogon Constituency seat but im lose by ova 2,000 votes.






