Africa Headline Lifestyle

No more beauty pageant for me for now’ – Chidimma Adetshina

Miss Universe Nigeria, Chidimma Adetshina, wey emerge first runner up for Miss Universe 2024 pageant competition don tok say she no go participate in any beauty pageant again for now as she wan focus on herself and on her education.

Chidimma tok for exclusive interview with BBC Pidgin when she land Nigeria after her successful outing for Mexico wia she make record for di kontri.

“I wan put pageant to bed right now, but I go focus more on my education and obviously establishing who Chidimma be, more into runways, more into acting, so many tins I go like to touch on and really see wia my potentials fit go.” Chidimma tok.

Di 23-year-old, wey represent Nigeria for di Miss Universe competition, compete alongside 125 representatives from oda kontris for di 73rd Miss Universe pageant, wey happen for Arena CDMX for Mexico City, on Saturday 16 November, 2024.

On Saturday night, Miss Denmark, Victoria Kjr Theilvig win di 2024 Miss Universe title while Chidimma emerge first runner up for di competition.

Afta Victoria Kjr Theilvig win di crown, Chidimma emerge as di continental queen for Miss Universe Africa and Oceania.

LEAVE A RESPONSE

Your email address will not be published. Required fields are marked *